Tuesday 23 July 2013

BAD MARKET

BAD MARKET:::;
Bad Market is when you go in front of White
Garment Church to sell shoe or slippers,... I ask
you, Cele-church dey wear shoe.

Bad Market is when you dress to go church come
wear PINK top with BLACK skirt/trouser, but as you
bounce enter church, you come see say na dat
your colour una Church Choir wear dat sunday. As
you come siddon for back, people come dey look
you as one Choir member wey dey under
suspension.

Bad Market is when you chop the only fish head
(isi-azu/ori-eja) wey remain for pot of soup, without
knowing say na that fish-head your Malleh wan take
arrange nite-food for your Palleh.... My dear, na that
nite your Papa go disown if you no vomit that fish-
head.

Bad Market is when a lady dey sleep come dey
dream where she dey give birth for hospital bed.
The nurses come dey tell her pussssssssh, she just
dey push dey go. When she finally woke up, she
come see say na shit she dey shit for bed.

Bad Market is when you as a guyman, ask a girl to
give you her number after toasting her, she come
give you her papa number. You come decide to call
her at midnite for romantic chat... My dear your
name go turn to "error in connection".

Bad Market is when you don arrange your room
finish, come lie down on top of bed dey wait for one
chikala wey you invite to your house. As you hear
knock on, naso you rush as sharp guy go open door
thinking say na your latest chikala, you come see
say na your Landlord wey you dey owe 14months
house rent.

Bad Market is when you mistakenly use weed (igbo
leaf) cook jellof-rice thinking say na scent leaf or
curry leaf... My dear, na Fela or Bob Marley go wake
you up for New York when you eat the rice finish.

Bad market is when you as a babe, follow guy go
joint, you just dey chop every every, infact all the
gbogbontigbo na your belle e enter, isiewu, point
and kill, cowtail and gaot meat pepper soup,
peppered snail, fried peppered meat, fried
peppered gizzard and fried peppered turdey,...you
even drink red wine, akpeteshi, opaeyin, odeku,
palmwine, sapele water, infact ehn, you just guzzle
everything down, the guy sef pay, una come enter
room you come dey form for the guy say you dey
do menses, omo na their you go sabi say gobe dey
get gator.

Bad market is when, as a gallant babe your mother
slaps you, you just hiss and walk out on her due to
annoyance BUT your boyfriend beats you blue
black and yet after the beating, you will still
become a sanitation worker in his house then
afterwards you'l update you PM thus:::my boyfriend
brings out the best in me.....truth ehnnn, na
Amadioha go personally treat your f**kup

Bad market is when you do runs for school, enter
party wen be say dem don organise sugar daddy/
mummy wey dey wait you for inside room, you
enter the room after you don manya sotey your eye
don dirty but as you just enter the room, na your
palleh/malleh be the sugar daddy/mummy wey
dem arrange you for. Hmmm e don red be that.

Bad market is when you find yourself in Aluu on a
friday morning, stealing a glimpse at a pretty
babe.....mehnnn na Aluu5 dey load for your neck
be that because na you dem go take complete am
Aluu5.
.......Oya knack us your own idea of Bad market

No comments:

Post a Comment

whizqidconcept@gmail.com